… Beats Davido, Burna Boy, Chris Brown to
Tems win award for di Best African Music Performance winner wit her hit single “Love Me Jeje”.
She beat Burna Boy, Chris Brown, Davido, Asake, Yemi Alade and odas to emerge winner.
“Dear God, thank you so much say you put me ontop dis stage and give me dis team,” Tems tok for her acceptance speech.
She add say “Tomorrow na my mum birthday, and na she dey here for her first Grammys, and I just wan thank you, mum, becos she don really do a lot for me and my brother.”
Dis win don add to her already impressive Grammy journey.
For 2023, Tems collect her first Grammy award for Best Melodic Rap Performance wit Future ‘Wait For You’ wey feature Drake for di 65th Annual Grammys.
For 2025, Tems get a total of eight nominations, wit “Love Me JeJe” wey win Best African Music Performance.
She also dey nominated for Best R&B Song wit “Burning” and Best Global Music Album wit “Born in the Wild.”
Tems, 29, wey her real name na Temilade Openiyi, don see ogbonge rise for her career.
Topics Wey Dem Resemble
Nigeria
Jollificate
Music
Another thing we de for inside dis tori
Nigerian Afrobeat stars Burna Boy, Tems, Davido, Yemi Alade & Wizkid,
Eviritin you need to know about Grammy Awards 2025
Leave a Reply